Kano State new Governor Yusuf order seizure of property wey belong to the state

All public places and assets wey dem allege se dem sell or convert to personal use under di immediate-past Umar Ganduje administration for Kano state, the new Governor Abba Kabir Yusuf don give order se make dem seize am.

E no dey afta dem swear Governor Yusuf into office naim he give approve the order  and him tok se na based on the transition advisory of him government under di New Nigeria People Party e take do am.

For inside one message for him Twitter page, Governor Yusuf tok se him team don notice se the last administration sell plots of land inside and around schools, for religious and cultural sites, for hospitals and clinics, for burial ground and even bush.

The Governor tok se di past administration still sell open spaces wey dey along the Kano city walls, and even other landed property plus assets within and outside the state wey be Kano State Government get.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x