Long queues dey for petrol filling stations as pump price increase to N557

Nigerians don dey buy petrol for more than four hundred naira per litre as queues dey long for petrol filling stations across we contri.

The Nigerian National Petroleum Company Limited don approve new petrol pump prices as high as five hundred and fifty-seven naira.

This wan dey follow Presido Tinubu announcement se petrol subsidy don go.

Nigerians wey dey for long queue dey hope rush to full their tanks and gerrycan with petrol.

Lasgidi FM Najite Atirene follow some pipu for queue inside Victoria Island tok and dem get mixed rections to the situation.

Some tok se make presido Tinubu follow process wey no go make the pipu suffer the petrol subsidy removal effect.

Other pipu tok se the removal of the petrol susbsidy no be way to go.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x