Many many Ogbonge people don waka comot from Rivers State APC

Many many Ogbonge people don waka comot from Rivers State APC.

The latest person wey resign for the party na Prince Tonye Princewill wey be Rotimi Amaechi personal person.

Princewill for one letter wey him write give the APC oga dem, say him de waka comot for the party because say the party give their presidential and their vice presidential candidates to two Muslims.

Another person wey comot for the Rivers State APC na former information Minister wey be Ibim Seminitari.

As that one de happen so, APC leadership for Rivers State don talk say as people de comot for the party, na normal thing as election don de reach.

APC Publicity Secretary for Rivers State, Chris Finebone for one interview with Lasgidi FM, tok say many people comot for the party sake of say dem wan pursue their political ambition.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x