New Ministers don start work

Oga Presido Bola Tinubu Ministers don start work.

The ministers hold their first meeting with their staff.

For the Ministry of Finance, Wale Edun who be Coordinating Minister for the Economy, say him go reduce pain on top government’s reform policies.

For him side, the Minister wey de charge for Ministry on top Marine plus Blue Economy, Gboyega Oyetola tok say him go focus on issue we de affect Nigeria marine sector.

Also; the new Minister for Justice plus Attorney General of the Federation, Lateef Fagbemi, say make people advise am and criticize am if him no do well.

For him side, Minister on top Solid Minerals Development, Dele Alake, say Oga Presido Tinubu choose am sake of say him trust am.

Still on still, former River State Governor, Nyesom Wike wey be Minister for Federal Capital Territory, give threat say, him go destroy houses wey no follow the Abuja Master Plan.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x