NLC don threaten say dem go strike over ASUU strike

Nigeria Labour Congress don threaten say dem go call their members to go strike to take support Academic Staff Union of Universities wey don de on strike for three months.

NLC President, Ayubba Wabba, wey tok this one for pre-May Day rally in Abuja, say Federal Government no gree hear ASUU demands.

Wabba tok say the Congress go give Federal Government 21 days deadline to take meet ASUU demand.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x