Peter Obi don announce Senator Datti Baba-Ahmed as him running mate

Labour Party presidential candidate, Peter Obi, don announce before-before federal lawmaker Senator Datti Baba-Ahmed as him running mate for the 2023 general elections.

Obi wey make the announcement for one event inside Abuja, say him take the decision after him rub mind with many people.

Peter Obi wey be  before-before Anambra State former Governor, tok say Baba-Ahmed na person wey sabi make money and fit still do well as better leader.

Baba-Ahmed for him own side come still tok say him decision to accept to be Peter Obi Vice President candidate na because say him wan save Nigeria.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x