Peter Obi tok se Nigeria Democracy dey inside gbege

The Presidential candidate of Labour Party, Peter Obi don tok se Nigeria democracy don enter deep gbege and he dey worry for the destiny of the kontri.

Inside one message for Nigeria Democracy Day, Peter Obi se the kontri go continue to dey find solutions sake of se too much basic problem plenti.

Peter Obi tok se pipu dey jollificate for the June 12, 1993 election for Nigeria becos na reminder of wen Nigerians freely choose transparent voting method.

Obi tok se votes wey dem cast for the election thirty years ago dey show the true choice of Nigeria pipu without se ethnic or religion or even region divide dey.

Inside one statement ontop him twitter handle, Peter Obi tok se the current state of politics for we kontri det tell different tori from June 1993 record.

Obi tok se the current electoral system no dey credible and e no fit make pipu get trust and confidence for am.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x