Presido Tinubu salute MKO Abiola for him Democracy Day Speech

Presido Bola Ahmed Tinubu dey tell Nigerians se mak dem no tek we democratic governance for we kontri for granted.

Presido Tinubu se those pipu wen dey during by the time of military rule for we kontri understand the difference between the freedom of democracy and the lawlessness of dictatorship.

Tinubu tok this one for him first Democracy Day broadcast to Nigerians, as he salute late Chief MKO ABIOLA, the winner of June 12, 1993 presidential election wey dem cancel.

Apart from ABIOLA, the Presido still hail Kudirat Abiola and late Pa Alfred Rewane for the sacrifices dem do so the Nigeria Democracy go stand.

Presido Bola Ahmed Tinubu still look side b side the 2023 general elections and June 12. 1993 election wey dem cancel.

Presido Tinubu tok se as the elections tight show se democracy for Nigeria dey alive.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x