United Arab Emirates don lift the visa ban wey dem placed on top Nigerian travellers after almost one year.
Oga Presido Bola Tinubu Special Adviser on top Media plus Publicity Ajuri Ngelale tok this one for statement.
Ngelale tok say lifting of the visa ban come after agreement between Oga Presido Bola Tinubu and United Arab Emirates Presido, Mohamed Bin Zayed Al Nahyan.
Ngelale tok say with the agreement, Etihad Airlines and Emirates Airlines go immediately resume flight schedules inside and outside Nigeria.