Appeal Court reverse judgement wey comot Ebonyi state governor Dave Umahi and him deputy from office

Court of Appeal for Abuja don reverse the March 8 judgment by Justice Inyang Ekwo for the Federal High Court wey sack Governor David Umahi plus him Deputy, Kelechi Igwe sake of say dem comot from Peoples Democratic Party go All Progressives Congress.

Three-member panel of the court wey Justice Haruna Tsanammi be their leader, for their judgment say 1999 Constitution no provide any punishment for Governor or Deputy Governor wey comot from the party wey dem take win election join another party.

The court come still hold say, the only option wey political party get if dem no like as their governor or deputy comot from the party na to go through impeachment.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x