DSS carry suspended CBN Governor go court

Di Department of State Services don carry suspended Governor of the Central Bank of Nigeria, Godwin Emefiele go Federal High Court in Lagos.

Dis arraignment dey happun afta one Federal High Court for Abuja order di DSS to charge Emefiele before court or make dem release am nothing more than seven days.

Tight security, with some DSS operatives dey ground wen dem carry am go di court dis morning.

We gather se dem no allow tori pipu go di small courtroom where dem dey hear di case, but di ones wey fit manage to perch for window report se dem see when dem call Emefiele to enter dock.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x