Oga Presido Buhari welcome Supreme Court judgment on top Osun Governorship election

Oga Presido Muhammadu Buhari don welcome Supreme Court judgment on top Osun Governorship election wey confirm Adeola Adeleke as Osun State Governor.

Oga Presido Buhari for statement wey him Special Adviser on top Media plus Publicity, Femi Adesina issue, tell Osun State people make dem support Governor Adeleke make him for succeed.

For him side; former Vice Presido and PDP Presidential Candidate, Atiku Abubakar, tok for Twitter, say him belle sweet am well on top the Supreme Court judgement as e take concern Governor Ademola Adeleke.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x