Senator Amosun don join 2023 Presidential race even as Osinbajo plus Bakare don pick apc forms

The list of pipo wey wan contest the 2023 presidential ticket under the All Progressives Congress don continue to de increase.

This de happen sake of say, former governor for Ogun State wey still be Senator for National Assembly, Ibikunle Amosun don join the race.

Senator Ibikunle Amosun declare for one event wey hold for the Shehu Musa Yar’Adua Center for inside Abuja.

Ekiti State Governor, Kayode Fayemi wey still join the presidential race on Wednesday, na some of the important pipo wey come the event.

As that one happen, Pastor Tunde Bakare wey be the serving Overseer of the Citadel Global Community Church, don pick APC one hundred-million-naira presidential nomination forms.

Oga Vice Presido Professor Yemi Osinbajo, self don pick APC presidential nomination and expression of interest forms.

However, reports wey comot from inside Abuja dey show say Oga Vice Presido no pick the form by himself instead na Senator Kabiru Gaya come pick the form on him behalf.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x