Oga Presido Muhammadu Buhari don swear in Justice Ariwola Olukayode as Chief Justice of Nigeria. Justice Ariwoola take the judicial oath of office today for one short ceremony for the Council Chambers for Abuja before the Federal Executive Council meeting start. Vice Presido Yemi Osinbajo, ministers, other Justices for Supreme Court, Oyo State Governor, Seyi Makinde plus…
Fire don destroy some parts for Kogi State House of Assembly building. The Speaker for the Kogi State House of Assembly, Mathew Kolawole wey follow tori people tok for the Assembly Complex, say the house go allow security agencies investigate the matter.
Light no de Abuja, Lagos plus other Nigerian cities sake of say National Grid don collapse again for the eighth time for 2022 Ikeja Electric, Abuja Electricity Distribution, Eko Electricity Distribution Company, Benin Electricity Distribution Company and Enugu Electricity Distribution Company for different different notices to them customers say the national grid collapse around eleven AM today.
Lagos State Government don extend okada ban to 4 more local government areas, the ban so go start from September 1st. This ban still cover five local council development areas. The local government areas wey this ban cover na Kosofe, Oshodi-Isolo, Somolu plus Mushin Local Government Areas. The Local Council Development Areas wey this ban cover na…
The Inspector General of Police, Usman Alkali Baba don order say make police officers provide security for schools, hospitals and other important places for we country. The IGP still order say make police officers increase normal patrols, stop-and-search operations plus raids for hot spots. Police tok tok person wey be Muyiwa Adejobi confirm the IGP order for…
50 people don die for flood gbege wey shele for some parts of Jigawa State. Jigawa State government people confirm say the flod gbege wey happen pursue plenty people comot from their house. Executive Secretary for Jigawa State Emergency Management Agency, Sani Yusuf, tok say the flood destroyed plenty houses for inside the state.