TMG dey advice Presido Tinubu to work on di failings of di 2023 Electoral process.

Di Transition Monitoring Group don dey worry about di Federal Government rejection of di European Union report on the 2023 general elections.

Di TMG Chairmo, Auwal Rafsanjani, tok se di wetin di Eu Election Observation Mission Observation put for their report na di same observations wit local observers and civil society groups wey still monitor di elections.

Rafsanjani tok se wetin di government and di Independent National Electoral Commission suppose do na to review di report and work on to tek correct di problems wey dem notice for di electoral processes.

Him dey advise Oga Presido Bola Ahmed Tinubu to gada mind gree to di failings of di electoral process, wey him tok se dem fit confirm am wit di violence wey follow di election and plenti election petitions for different Tribunals.

Meanwhile; a lawyer to di People’s Democratic Party tok se dem don tender di EU Election Observation Report as evidence for di Presidential Election Petition Tribunal wey dey Abuja.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x