Obasanjo tok say him no get any candidate for 2023 presidential election

Former Oga Presido Chief Olusegun Obasanjo tok say him no get any candidate for the 2023 presidential election but him national agenda for we country.

Obasanjo tok this one when him visit former Head of State, General Abdulsalami Abubakar for Minna, Niger State on Sunday.

The visit na the latest meeting wey Obasanjo don get with ogbonge people dem.

Earlier for the month, Obasanjo host APC presidential candidate Bola Tinubu for him house for Abeokuta, Ogun State.

Days after that one, Obasanjo still meet Rivers State Governor Nyesom Wike and Labour Party presidential candidate wey be Peter Obi for London, UK.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x