Tribunal go deliver jugdement of Presidential election on Sept 6, 2023

Di Presidential Election Petitioner Court go deliver judgement of di petitions wey dey challenge Presido Bola Ahmed Tinubu election victory, on Wednesday dis week, September 6, 2023.

Di Registrar of di Court of appeal, Umar Bangari, confirm di date give tori pipu and tok di court go show di judgement session for any TV station wey wan broadcast am live.

Banngari se di journalists and lawyers wey dem go allow showcase di judgment na di one wey dem don accredit.

Newsletter

Stay in Touch with Us, Subscribe to Our Newsletter


Watch Live

x