Federal Government don release independence anniversary programme The Minister on top Information plus Culture, wey be Lai Mohammed for one press conference for Abuja say this year 62nd Independence Anniversary go start with one special church service this Sunday. Him tok say Federal Government go hold public lecture to take discuss Nigeria National Unity for Thursday next…
The Federal Government don direct say make all flags fly for half-mast for Queen Elizabeth the Second. Minister for Interior wey be Rauf Aregbesola make the announcement for one statement. You remember say Oga Presido Buhari for him condolence message tok say Nigeria history no go de complete without the queen.
Federal Government don invite members of governing councils of public universities to meeting on top the ASUU strike. People wey go come the meeting wey go shele for inside Abuja on September 6, 2022, na pro-chancellors, vice-chancellors plus chairmen for governing councils for federal universities. People for the meeting wey the National Universities Commission go host, go…
The Committee of Vice-Chancellors for Nigerian Universities don beg Federal Government say make dem end ASUU strike. The committee say Federal Government yarn say money no dey to take fund Nigerian universities dey very painful. The Chairmo for the committee wey be Professor Samuel Edoumiekumo tell Tori people say ASUU demands no be for the union but…
The Federal Government don launch new Nigerian National Petroleum Company Limited. NNPC Limited been come after government unbundle the former Nigerian National Petroleum Corporation after the National Assembly pass Petroleum Industry Act. Oga Presido Muhammadu Buhari join other top-top people for the unveiling ceremony wey shele for inside Abuja and still feature performances plus tok tok. Oga…
Federal Government don declare Monday plus Tuesday as public holidays to take celebrate Sallah. Minister for Interior, Rauf Aregbesola, announce the Eid-El-Fitri public holidays for one statement wey the Permanent Secretary, Shuaibu Belgore sign. Aregbesola come dey call Muslims make dem continue to dey practice love, kindness plus sacrifices as Holy Prophet Mohammed take teach them.